Psalm 23 for Pidgin --- Confide Tawo

Have you ever imagined the pidgin translation of psalm 23 ?
I came across this and after after few crossings and addons I've decided to share this with you.

Enjoy ....


The Lord na my shephard, i dey gidigbaa
E nake me sidon for where betta dey flow and come put me next to stream make mai bodi thermocool.

E panel beat ma soul come spray am white, come dey lead me dey go through express road of righteousness sake of Hin name. Walahi, if i waka pass where arm robber, 419 and juju people plenty, come even join okada reach valley of the shadow of death sef, mai bodi dey inside cloth.

Your rod and staff nko? Na so dem dey like back bone dey comfort me.
You don prepare egusi and pounded yam and plenty-plenty meat, fish and okporoko make i chop. all mai enemies dey look waa waa.

You rub me for head wit vaseline intensive lotion. Mai cup na river Niger wey overflow hin bank.

True true, betta life and mercy go gum mai back till I quench. And man pikin go tanda for God house from lai lai to lai lai.

GOD ALMIGHTY NA U BIKO.

AMEN 

Did you enjoy it ?

No comments:

Post a Comment